@bbcnewspidgin: Di family of 28-year-old Mene Ogidi dey seek justice for di extra-judicial killing of dia son by Nigerian police officer ASP Nuhu Usman for, Effurun, Delta State, south-south Nigeria. For inside interview wit BBC News Pidgin, Ogidi sister tok wetin happun bifor im death. Di Nigeria Police Force on Wednesday 29 April say dem don dismiss ASP Nuhu Usman and oda officers wey bin dey involved for di killing afta di investigation wey dem run. According to di Force tok-tok pesin, DCP Anthony Okon Placid, dem go hand ova di officers to di appropriate judicial authorities for prosecution for dia roles for di extrajudicial shooting. Edit: @temfilms606 #bbcnewspidgin #delta #nigeria #police