@warriaproko1: Formar President General of Ofuoma Community Naim Go Give His Boy Wife Obenitatata. News wey waka zabu-zabu like Agbarho single mother enter Warri Aproko #Studio from Ufuoma community for Ughelli say na Olorogun Chief Godfrey Etabuko, wey be former president General of the community naim area gbab r one hotel wey he program his late boy wife go doke yesterday. We know say many of una go say the man no do anything wrong since his boy wey marry the woman don lëggo, oya make una hear the real story now........... Na during the tenure of Chief Godfrey Etabuko, as president General of the community naim crisis take happen for the community and na because Chief Chief Godfrey refuse to step down as president General of the community after the end of his tenure naim lead to the crisis and na the husband of woman wey he dey doke now be his NUMBER ONE soldier 🪖 wey dey help am phìqh† the crisis that time, and na during that crisis Chief Godfrey rivals kpuff the guy wey his nickname na Alignment. After the D£∆†h of Alignment, police ∆₹₹£s† many community leaders and the matter go court before them con later settle and compensate Alignment family. Our reporter tell us say na Chief Godfrey account them pay the compensation money enter during the settlement. Few weeks after Alignment lëggo, naim Chief Godfrey begin toast Alignment wife, say he don dey like her since when her husband still dey alive. According to the woman, she tell chief say, her husband still dey mortuary, them never buřy am talkless of to return bride price, chief say male she relax, say he go help the woman ßury her husband, after enough pressure na so the woman take begin bend døggy-obenitatata for Chief. Few months after the woman don dey bend døggy for Chief, naim the woman pikin fall s!¢k, and them begin treat from one hospital to another but no improvement, until e con clear say na eriwin (accestors) don kolobi the pikin, naim the woman con go confess to her mother Inlaw say Chief Godfrey dey doke her. Finally, she con go confess to her late husband entire family. After the confession, the family elders in their own wisdom come tell the woman to call the chief to tell am say make them meet for the hotel as e don tay wey them meet and as this rain dey fall so, her kpekus dey do her GBIM-GBIM-GBIM, As Chief hear say kpekus dey do GBIM-GBIM-GBIM, Naim he quickly rush go the hotel yesterday with strong manpower for him pocket, not knowing say Alignment family youths don mount the area dey survey, na so them take gbab the omokri Chief for the hotel and them move am immediately g their family Compound. #viral #warri @#foryou #virale #fypppppppppppppp

WarriAproko
WarriAproko
Open In TikTok:
Region: NG
Monday 20 July 2026 13:53:40 GMT
14527
525
31
124

Music

Download

Comments

wisdomjerome2
Wisdom Jerome :
Una even respect am even allow am sit for chair sef 🤦‍♀️
2026-07-20 20:50:49
0
tegabillionz.001
Tegabillionz.001 :
Nothing we nor go see.
2026-07-21 04:35:59
0
kendoswavey
Kendo Swavey :
She’s the problems here . Leave the man. If she no gree, he nor go force her . This case is different. And beside, her husband is gone . Make una use sense handle this case .
2026-07-20 22:04:36
0
favyduke2
Dfavour :
Nawa ooooooo
2026-07-20 21:15:44
0
snippalee29
Snippa lee :
So Una Dey blame only the PG leave the woman Abi 😏
2026-07-20 20:04:57
6
prodigaldaughter5
Self aware child ❤️🌹❤️🔏 :
God Abeg, una dey turn person situation to una selfish interest , God forbid some men
2026-07-20 20:00:17
1
erukess
Kess :
She meet the man more than 5 times even after telling family and close friends. They are both guilty
2026-07-20 21:32:36
3
big_gtac
Big GT :
He no force her na
2026-07-20 23:38:24
0
eli181059
Eli :
CONGRATULATIONS
2026-07-20 19:31:04
1
lizzyeth0
okiemute elizabeth :
na wa oo
2026-07-20 16:04:02
0
joy.nice.830
joy nice :
The noise too much
2026-07-20 20:00:11
0
real.sapele.amebo1
Real.sapele.amebo :
Wahala no Dey finish
2026-07-20 14:40:42
0
fb_beautybar_
Sapelemakeup&contentstudio :
Nawa o
2026-07-20 22:10:37
0
martinsakp
Martins Akpos :
Nawa oooo
2026-07-20 19:36:41
0
eli181059
Eli :
where is past 2
2026-07-20 19:36:12
0
alfred.wanna.du
Stephen :
I'm from Ofouma make owner drive the man from the community.
2026-07-20 19:45:25
1
candybluxury01
CandyB luxury 💞 :
and she go meet the man more than twice yet una dey blame only the man why she no tell her family the first time wen the man tell her to come meet am. she even dey collect money from the man on a stead
2026-07-20 21:03:49
2
realtalkwithjuliet
AGODA JULIET :
NA WAH OH
2026-07-20 15:38:58
0
daddy.david924
daddy David :
the woman still enjoy the man fuck
2026-07-21 05:47:24
0
katekennedy86
katekennedy86 :
some women no get 😁
2026-07-20 21:02:27
0
_eseogheneloveth
Eseoghene 🥰🥰🥰 :
From the begin the man nor want make u tell any of ur pple but as the pikin Dey sick he tell u say make u go ask ur pple nawaoooh
2026-07-21 04:55:35
0
brydanielsempireltd
Brydanielsempire :
😁😁😁
2026-07-20 19:48:20
0
warriaproko1
WarriAproko :
🥺🥺🥺
2026-07-20 13:57:54
0
edithconcept01
EDITH CONCEPT 💄 :
😳😳😳😳
2026-07-20 21:18:33
0
real.sapele.amebo1
Real.sapele.amebo :
😳😳😳😳
2026-07-20 14:40:33
0
To see more videos from user @warriaproko1, please go to the Tikwm homepage.

Other Videos


About