@bbcnewspidgin: Faith na Favour Agbro twin sister. For dis interview wit BBC News Pidgin, Faith recall di last moments of her sister and how she notice say some tin don happun to Favour. Faith say she notice changes for her twin emotions afta she return from Asaba. Di death of 20-year-old Favour don cause many tok-tok for social media afta tori come out say she kpai hersef afta her alleged visit to ‘Odogwu Asaba’, one content creator wey im real name na Ifeanyi Ogbonna. Di content creator currently dey for police detention for Asaba, Delta state. Producers: @Tami x @TemFilms #bbcnewspidgin #favoragbro #odogwuasaba #death #nigeria