👑𝘈𝓎 𝚂𝓹𝓮ทc𝐞𝔯║▌💕✿ :
Omo, if I talk my own eh, una go come find me 😭😭 Since this year, I don pray, cry, still wipe my eyes. My mama don nearly catch me plenty times as I dey cry I go quickly tell am say something enter my eyes. 😭😂 I graduated last year, but I honestly didn’t know life would turn out this way. I be first child, and yesterday I cried to God say, “I don’t want to end up like this. I don’t want to end up like my mother, limited and unable to do the things I know I’m capable of doing.” Because I know say there’s better out there, and I know I will get there. ❤️🩹 I don find work, I no see. Three separate businesses wey I don try, everything don fumble. But somehow, I still dey believe in God. 🙏🏽 Person fit see me and think say I get my life together. Dem no go know say sometimes I dey like this. There are days wey even 1k I no get even now I no fit boost of 500 . If we wan cook and my mama never bring out money, I fit just dey there. Shame go nearly hold me because I know say at my age, I don suppose dey assist my mama, even if na small, instead of her still helping me. She no dey disturb me oo. In fact, she dey always tell me make I chill, say God dey. And honestly, I’m grateful ❤️Thank God for her, and for the few friends wey dey come through for me God bless una. And my cousin brother, Tecee, your own no go spoil Ajeh, God bless you ❤️🙏🏽 But in all of this, I still believe say things go better. I may not know how or when, but I know say I no go remain like this forever. One day, I’ll look back at this version of myself and say, “See how far we’ve come.” 🥹❤️🩹 God got me. And I’ll keep going🙏
2026-09-22 09:04:02