BELLA SUGAR📹 :
My daddy and mummy, my brother and sister, listen to this story. E no dey easy! 😂
My name na Bella Sugar, popular salisa—sorry! 😂 If you calculate everything together, na USA and Italy! 😂
Before, I dey go one church. I dey plant yam, but rabbit dey chop my yam, so I change church.
For my new church, everybody dey give testimony. Pastor ask, “Bella Sugar, why you no get testimony?”
I say, “Pastor, e no dey easy to be Bella Sugar! Before, rabbit dey chop my yam, but since I come your church, rabbit no dey chop am again!”
Pastor say, “Thank you. So wetin you go give God?”
I say, “Next Sunday, I go bring yam!”
Next Sunday, pastor say, “Where Brother Bella Sugar, Owan for Tito, content creator, wey promise ten yams?”
I say, “Pastor, before I talk that testimony, my brain don hack! The yam wey I promise you, na yesterday I just plant am. E never even get leaf!” 😂
Pastor, abeg use my head no be floor! 😂
My sister and brother, clap for me! And abeg, follow this page—I go make money! 😂
2026-09-25 04:15:48